Chidinma Ekile, that small bebe wey dey sing like Angel and
wey plenty of our Gonfabi artistes dey crush don talk something wey shock
everybody o. Na recently the nane wey bin win MTN project fame that year go
write am on top her instagram page say her last song wey she sing, MARTHA, where
she for feature her mumsy, say na her mama Mrs. Martha Ekile she dedicate am
to.
She say she dey take the song hail her mama cos the woman
cry tire when she born am and dem yarn her say her bebe, our own chidinma close
eyes finish, say she dey totally blind. She say na for 16 days the mama dey do
marathon cry and her papa dey pray dey go, till God do miracle touch am and
open her eyes on the 16th day after dem born am. And that na why she
wan dey use her levels and resources to take dey care for pipu wey get eyes
palava and those wey blind patapata. I say 3 gbosa for you my crush of life.

No comments:
Post a Comment