Wednesday, November 19, 2014

WIFE CHUKE HUSBAND DIE ON TOP MONEY ARGUMENT FOR LAGOS





Na last week Wednesday the bad mata shele for TK Balogun Street, igbo Olomu, Ishawo around 2am when the 27 years old woman, Folashade Shodiya and her 39 years old husband, Jude Igbinedor dey argue on top money. 2 of dem dey run things together now for 7 years even though dem parents no gree support dem union.


Tori even yarn us say e no tey wey 2 of dem pack enter that area and say na jeje dem dey go o, except say the woman dey quick vex and her husband dey smoke. Dem say the woman bin don borrow 1k from persin say she go give am back when her husband come back from him my mama place where he go. And when he come back he carry money follow body but he no wan gree settle the gbese and na wetin cause argument be dat. The wife sha talk say na the husband first take hanger hit am before she carry knife take scare am and mistakenly chuke am wey kpain am. 

No comments: