Tuesday, November 18, 2014

WALAHI I NO FIT COUNT THE NUMBER OF CARS WEY I DON THIEF NA SO ALHAJI AKOREDE DEY CONFESS O.




One car thief, Alhaji Kabiru Akorede wey police for Lagos don catch say him no fit count how many cars he don thief for him life o. Tori say na for him house wey dey NEPA Quarters, Ishash na him SARS for catch the 42 years old Gonfabi.


Dem say him and him goonz bin don go Victoria Island on September 12 go thief the Toyota Prado car of one Mr. Albert Omisore and dem don carry am give one of dem padi say make he go sell. Dem say dem bin don first catch the guy early dis year and him mater still dey Ikeja Magistrates Court. The guy san him go mecca in 2010 and na last year him strat to dey thief car but sha he no fit count again how many cars he don thief.

No comments: