Police for Lasgidi don catch one bad guy, Moses Timothy for
Fasha street wey dey Iju Area on top say he flog him neighbor one Caleb
Adebambo. The mata shele early momo on Wednesday wen the Baba wake up say make
him go collect rain water. And the guy say the baba push am for passage.
Tori say na immediately the Baba apologise say make he no
vex, him no do am intentionally but befor he go fit even talk am finish, the
guy don sound am better slap, come even go carry iron chair wey he take woze
the Baba for head. Wen dem show him face for court he say na lie, him no dey
guilty but dem sha don grant am bail for 200k.
No comments:
Post a Comment