Tuesday, November 11, 2014

WHETHER YOU LIKE OR YOU NO LIKE, NA ME GO CLIMB NAIJA THRONE IN 2015, OKOROCHA DEY PROPHESY




Imo State Governor Rochas Okorocha on Monday for Enugu don talk him mind say him too wan run for the president race for next year election, say Woli wey sabi don yarn am say he go win. In 2015 na me go be the presido for Naija,” Na so Okorocha yarn to plenty pipu wey carry broom for hand who be APC pipu for the rally wey beta naija and APC pikins dem attend. The governor, who yarn with Igbo and English language say the way he go take climb throne in 2015 go shock everybody especially PDP pipu.


Tori say na so so clap the pipu wey dey there dey clap like computer and him dey let dem klnow say na lie o APC no say presidential candidate must come from the North, say make we dey look am o cos na him name go be number 1 on top the list of APC presidential aspirants wen dem dey count dem even dem go mention him name before that of Oga Muhammadu Buhari, Oga Atiku Abubakar plus  Rabiu
Kwankwaso.

No comments: