One Naija Air Force helicopter don fall again on Monday near River Benue for Damare, Girei
Local Government Area for Adamawa State. The thing bin carry five crew members wey be American military personnel plus one Naija pikin.
Local Government Area for Adamawa State. The thing bin carry five crew members wey be American military personnel plus one Naija pikin.
The Americans we hear say dey among the 40 United States
military personnel wey come help we military for the gbege wey dey shele with
dem Boko Boys for the North-East. One
persin
wey see am with him korokoro eyes who dey stay close to the place where
the thing fall, yarn one reporter say the helicopter fly fly around the area
for about 30minutes before e fall.
He say him rush go the place but see say all the crew members,
except the pilot, don try drag them body commot from the helicopter. The
witness even yarn say before security personnel show face for the place, he hear
one of them dey yarn him padis say make dem put fire for the helicopter. The pilot plus two other people woundjure break leg and hand for the matter. na Air force ambulance came later carry all
of dem commot.
But the Oga megaphone for we military, Maj.-Gen. Chris
Olukolade, who confirm the say na training the helicopter bin dey do for that
area.

No comments:
Post a Comment