Tuesday, November 11, 2014

NA WA O..DIS GUY DON TAKE VEXNATION KPAIN HIM PADI OF LIFE O




One kamoru Kushimo don chuke and kpain him long time padi , 25-years old Olawale Salau who be lottery agent o. The bad thing shele on Wednesday, last week for Alafia Street, for Iyana Ipaja area of Lasgidi. PUNCH Metro hear say the person wey don bin done try free kamoru from police hand because say dem bin arrest am say he hayaj persin for dem neighbourhood.


We hear say na since den Salau don dey yarn him friend wey no get job say make he bone thug life. One persin wey dey stay for the afrea say na all dis kain talk make Kushimo vex come go hayaj  Salau say he dey report him matter round the world wey make pipu dey look am like gonfabi . Dem say later that day na so so abuse he dey abuse am o, wen all of dem gather go high for one joint but as he talk reach salau no answer am at all na pipu come dey try hold am say make he stop but he no gree.

Salau say if na for dem friendship to end no qualms, make dem make am so but all of dem shock o, wen Kushimo say dem gats to fight o and as pipu dey try settle the gbege na so Kushimo grab bottle and break am for wall, take woundjure some pipu around but salau no gree let am use am and na so some agbalagba for the area come separate dem say make everybody waka him own separately.

But Salau no know say him guy don go perch for inside darkness dey wait am with knife. And na so he go chuke am die o. The PPRO, DSP Kenneth Nwosu confirmed the mata say dem don carry the dead body go mortuary.

No comments: