Tuesday, November 18, 2014

NA WA O…CULTISTS DESIGN ONE GUY FOR LASGIDI ON TOP SAY HE DEM RUNZ DEM BABE





Dem say some cult guys go hayaj Olawale Street for Ire Akari Estate wey dey Isolo Lagos where dem for go design one barber, Nnakaeye Eze on top say him dey runz the nane of one them goons, Darlington. Dem say the guys wey be like 11 bombard the place with different instruments like axes and knives, dem say na around 10:30 pm the Aiye Boys show face.


Eze wey him eyes still dey chuke say if no be say him get chance take run ni, he for don kpain now, cos say na dem top men come him place, Darlington and Big 7, say Darlington say him dey runz him babe. But sha o the guy deny o, say him no dey chop the guy yam for him back o as per say him don marry don born sef. He say dem no just wan kpain am o, dem scatter him shop still thief him wallet where him for get 21,000.

No comments: