Friday, November 14, 2014

NO TELL ME NONSENSE SAY NA MISTAKE YOU TAKE SHOOT O, NAIJA POLICE PARA FOR DEM OFFICERS.




Naija police dom warn dem officers make dem stop to dey claim say na mistake dem take carry gun kpain innocent naija pipu again o. Na vanguard report say the Oga Megaphone for Naija Police, mr Emmanuel Ojukwu yarn dem that koko.


He say shey dem know say gun no fit shoot if dem no kock am, and persin no dey kock gun if 
no be say him wan shoot. So e no get how persin wan take carry gun, kock am well and carry am face persin come pull the trigger come start go dey cry say na mistake. He say Naija Police no go dey here all those kain fabu story again o, so make dem re-arrange themselves cos anybody wey do am again go shock o, wetin dem go take him eye see.

No comments: