Tuesday, November 11, 2014
E TAYA ME O, NA EVERYBODY WAN RUN MY PACKAGE NOW, EVEN CHINKO MEN DEY TRY DEM LUCK- PRINCESS
For one recent interview with Yes! magazine, comedienne Damilola Adekoya wey everybody know as Princess say she don dey get plenty toasting from men since her marriage fall. But sha o many of dem na chinko o.
She say na since the first day wey her marriage scatter na him different guys don dey cut eye for am even chinko men too dey try reason am. She say e be like say dem watch her and read about her and her marriage wey crash on top the internet ni cos e dey shock am how persin wey no fit yarn oyijbo make he no squeeze face too go dey tell am say he wan date am. Say the level taya her o.
She say na so so thank she dey thank dem o, say una do well say una reason me o but she dey always clear dem say na how to make her career blow be her concern now o, therefore so marriage no dey inside her dictionary again for now.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment