The
police for Abia State don catch one danfo wey dey carry 13 Naija babes wey dem
age no pass 15 to 21 years wey dem dey export go Gabon alongside the badt guys
wey dey arrange the parole. PUNCH Metro hear say the bus wey get number
AYB349AE, dey go Oron, Akwa Ibom State, from where dem go package the babes
pass border but policemen wey dey do patrol catch dem for road about 7.40pm on
Friday, October 31.
The
say immediately wey dem catch dem na him dem forward march dem go the State
CID, Umuahia, immediately after the matter. The Police megaphone for Abia State,
ASP Ogbonna Godfrey don confirm the matter o say dem don transfer the babes
give the Nigeria Immigration Service.

No comments:
Post a Comment