Monday, November 10, 2014

NAWA O…….LASGIDI POLICE DON CATCH 2 BOYS WEY DEY CHOP INCH OTHER BANANA O!




The Lagos State Police don catch two teenage boys, Gideon Harrison plus Ifeanyi Ezeorji, on top say dem dey chop the forbidden fruit of each other for Ikotun side, Lasgidi. PUNCH Metro hear say Harrison na 19 years old and Ezeorji na just 14. Police hand touch dem on October 23 say the bad guys dey run package with inch other dey pass back enter other through the silencer, wey Oyinbo dey call sodomy. Dem say Ezeorji na S.S.S.1 student for Igando High School, Ikotun Road and Harrison don finish secondary school.


PUNCH Metro hear say na one Toheeb Adekunle, who dey stay for Muka Street, Ijegun Road and dey work inside Ikotun Motor Park, na him catch dem on top motion and go report the matter to the police. Adekunle yarn police say no be today o wey Harrison don dey run that kain yeye package with boys for the area.

When punch correspondent visit the area on Friday, one police taafia yarn say dem don carry the two boys go State C.I.D for Yaba say dem go charge dem to court soon. Wen dem go dem Ezeorji’s family house for Oladunjoye Street, Ikotun, his mama, Mrs. Chinyere Ezeorji, yarn  PUNCH Metro say her pikin na better pikin who no fit do dat kain thing. She even yarn say her own pikin na still virgin o, say na just street fight her pikin tell am say him dey watch wen dem catch am, say she never hear of the other gonfabi.

The Lagos State PPRO, DSP Kenneth Nwosu confirm am o say dem don even carry dem go court cos the bad thing wey dem do even dey against culture and religion. The Christian, Islamic and even the Babalawos no dey feel that kain yeye parole.

No comments: