NDLEA don catch one suspected drug smuggler,
Solomon Mama, say he carry waka 2.2 kilogrammes of something wey take body
resemble cocaine. Na for Murtala Muhammed International Airport dem catch the
27years old guy wen dem start to dey check pipu wey dey inside one Etihad
flight. Dem say na inside women shoe wey he carry enter naija from brazil he
for hide the cocaine
While Solo wey be Enugu pikin dey confess winsh he
say na the money wey dem wan pay am too big o, wey make am put hand for that
kain yanmayanma. The NDLEA Oga for the Airport, Mr. Umar Hamza, confirmed say
na true dem catch the badt guy. He say na bojuboju the guy dey carry him shoe
business do, as per say na inside the shoe sef he dey hide the bad levelz.

No comments:
Post a Comment