The Lagos State Police Command say dem don catch 26 pipu who
get hand for the kpain wey dem kpain one PDP, Mr. Sikiru Ogboye, on Sunday. PUNCH
Metro hear say dem hire the victim ni make he go monitor how dem they share Permanent
Voter Cards for Oriledu, Ibeju-Lekki Local Government Area for thestate when dem
bad guys attacked am around 2pm.
Tori yarn us say dem report the mata for Ajah Police
Division, Ajiwe, na so policemen go bombard the place and dem catch those pipu.
One former oga Minister of State for Defence, who still be governorship
aspirant, Senator Musiliu Obanikoro, condemned the way dem take kpain the guy,Ogboye.
He say him know say na dem APC arrange that kain bad thing . When Oga PPRO, DSP
Kenneth Nwosu, dey confirm the matter he say him no fit talk which party the
guy wey die dey but sha o dem don catch 26 pipu ands seize one pump action gun plus
a live cartridge from the suspects.

No comments:
Post a Comment