Friday, November 14, 2014

NA WA O…MAN WEY GET HIV TAKE TIPATIPA CHOP THE UNRIPE YAM OF 2 SMALL CHILDREN FOR BENUE STATE.




Police for benue State don catch one 32 year old oponu, Terkula Iorpuur wey dey stay for the back of Hemko Hospital for kanisho area on Thursday and dem show him face for court say he take by force chop the unripe ogbono of 2 small girls wey be sisters, one na 8 and the other one na 6 years old.


Olopa say wetin the bad guy do na rape under section 284 of the penal code, he even say na the uncle of the small girls report the matter to police on October 6 wen he notice say dem no dey waka well and Doctor confirm am say someone don do the girls strong thing. Na later wen den shine eyes for the small girls dem confess say na dem mama guy man, Iorpuur do dem. The baddest thing for the matter come be say this yeye guy, Iorpuur don get HIV for body. But sha tori no yarn us if he don carry am dash the small girls or not.

No comments: