Governor Babatunde Fashola of Lagos State on
Friday don take him own hand catch one of him pikin, the guy dey work with the Lagos
State Signage and Advertisement Agency, Israel Onyemaechi, say him dey drive
against traffic, he pass one way. Na for Awolowo Road, Ikorodu, he for catch am
when he go inspect projects for the Ikorodu and Epe areke area.
PUNCH Metro hear say the governor convoy
block the guy vehicle and dem bring am down from the blue bus wey dem brand LASAA.
Then say na beg the guy come dey beg Fashola o, but dem say BRF dey para o say
him dey think say pipu wey dey work for
the state suppose get brain dey lead by example and na him make dem seize him
car.

No comments:
Post a Comment