Monday, November 10, 2014

CHAI…………..THE WOMAN WEY HER HUSBAND TAKE CAR JAM DON KPAIN LAST LAST




The 30-year-old woman, Dupe Ikharia, wey her husband, Corporal Lucky Ikharia, take motor jam her legs on October 30 son kpain for hospital o. Tori say she kpef aound that kain 6.30pm on Friday, November 7 wen her case bad gan for one traditional orthopedic hospital for Mushin, Lasgidi.





Na last week PUNCH Metro report am say Lucky take bus jam him wife on top N2, 000 wey cause gbege. Dem say after the guy vex commot for there say make she die if she go die Lucky go to him house where he still go chuke dem one-year-old pikin, David, he chuke am die take exponse all the innocent pikin intestines. After he do all the bad tins finish na him also try to kpain himself but pipu no gree let am die sha and immediately he do am finish na him dem police catch am.




On Thursday morning wen the matter critical na him one nurse yarn punch say Dupe’s spinal cord plus one bone around her neck don woundjure for the matter. But na her elder brother, Mr. Segun Akiode, confirm am say she don kpain and say dem don go submit petition to Oga Commissioner of Police, Cornelius Aderanti, on Friday afternoon go submit petition. But sha o dem say dem no see Lucky the bad guy who do the bad thing again o, even for police detention.




When dem ask megaphone for Lagos State, DSP Kenneth Nwosu say where Lucky dey he say him go halla back but he never do till dem carry the gist.

No comments: