Wednesday, November 12, 2014

BABATUNDE KIDNAP HIM O, THANK GOD SAY I FIT ESCAPE





One 34-year-old man, Mr. Shola Balogun, don dey yarn tori how dem take kidnap am, and how him take mahnage escape for Abule Egba area inside Lagos. Balogun, who dey dig boreholes yarn PUNCH Metro say dem kidnap am last week Friday, November 7, by one customer wey he never meet before, who ne one Babatunde. Balogun even yarn say Babatunde deceive am enter him house for JolaOsho Street for Abule Egba, where him realize say o boy dem don kidnap you o.


Tori say after Balogun fit escape, he go report the mata for the Meiran Police Division. PUNCH Metro hear say na one customer, Sunday first call Balogun on top telephone, and say make he yarn with Babatunde, who wan dig borehole for him house. Na so Babatunde halla Balogun on top phone last Friday and carry am go the house where dem go dig the borehole. He say na so Babatunde who be about 60 years old take deceive am enter one of the rooms and lock am up.
Balogun yarn say him manage escape through the ceiling of the toilet like one hour later
When PUNCH Metro go the area on Tuesday, dem don lock the house and dem no fit reach Babatunde on top phone cos he don switch off him line.  

When dem halla Sunday on top the telephone, him refused to comment on the matter, say e don already dey police hand. The Lagos State Police PRO, DSP Kenneth Nwosu, saiy dem never fit sure say na kidnap amd investigation still dey go on.

No comments: