Wednesday, November 19, 2014

FULANI PIPU FOR NAIJA DON SUSPEND DEM LEADER COS SAY HIM DEY SUPPORT PRESIDENT JONA.





Miyetti Allah Kautal Hore, the association of all Fulani wey dey Naija don suspend dem national chairman, Alhaji Bello Abdulahi Bodejo on top say him dey chuke hand for politics. For one statement wey dem sign by Alhaji Wakili Ali Babangida after dem finish one meeting for Kano.


Tori yarn us say the statement accuse dem Oga say since dem turn oga dem 4 years ago dem no gree do election wey suppo e dey shele every 3 years, but wetin come dey vex dem pass na the recent one wey dem chairman do wey him dey go endorse am say make BROS Jona rule Naija again for te second time.

No comments: