Dem say na jejenly the man bin commot from Jos on Monday nite
o, with a bus wey get full passanger. But sha o as dem dey wan enter Lagos around
1pm na so dem see one policeman wey dey for inside a patrol car wey get plate
number C NPF 6843.
Tori say as the Oga police stop the car na so him ask for 50
naira roger and the driver yarn am sauy him no get change for hand say na 1000
naira dey him hand, he ask him pipu none of dem get na so nhe take stretch the
1k give the Oga police wey press P o, na so the Oga police vex finish say where
the driver say make him for get change. Dem say na so the oga say make the guy
come down and as him come down na so he shoot am and he run enter him car run
commot. Dem say the dribve don dey hospital now where dem for dey try heal am, but say him condition serious
sha.
No comments:
Post a Comment