Wednesday, November 19, 2014

CHAI…SEE AS PERSIN WEY NO GO PASS PRIMARY SCHOOL 419 A WHOLE OGA LAWYER, SAN





No be small mata o wen dem show the face of one guy wey no go pass primary school for ikeja High Court on top say he do jibiti for one Oga Lawyer, S.A.N. for that mata, Dr. Aliyu Salimon say him dey do screening for National Assembly ni for one Federal Government Job. Wen Oga Lawyer yarn he say dem force am pay 2.5million Naira enter one Skye bank Account. He say na for phone one Babatunde Moses call am o say make him send CV as dem dey try appoint pipu for one Federal job, he even pay 150k wen dem talk say dem wan take do security report.


But sha o talk say no be so o, na one of him padis Akpan ask for account number and him no give so him give am Babatunde Account and na collect dem wan go collect the cash when EFCC catch dem o. say him own hand no dey o. but sha o Justice Lawal Akapo say make dem go keep dem for prison because say na run him run commot from Kano after dem give am bail for one mata like that.

No comments: