Wednesday, November 12, 2014

EFCC CATCH WAYO MAN ON TOP 1 MILLION DOLLAR JIBITI




EFCC don catch one Jibiti wayo man o, Adekunle Balogun, wey dem still dey call Malan Salihu, on top say him hand no pure for one Jibiti wayo wey involve $1m. Dem catch the 44-year-old guy wey be say na OND he get for Textile and Polymer Technology on top say him 419 one Precious Emelue of N100m.

EFCC megaphone, Wilson Uwujaren, yarn say suspect lie make Emelue believe say him go fit help am collect him $1m from one Pakistani bank: Kan-Cern Limited, wey International Monetary Fund no greee let them pay am.

Uwujaren say Emelue claimed say in 2012, him meet one Mr. Perry Kandoharty, who be diplomat with the Pakistani High Commission in Lagos. And na wen dem dey gist Emelue yarn Kandoharty say him get experience no be small for deep sea fishing. And na so dem go agree to dey work together. Emelue say Kandoharty send am mail wey inform am say him don deposit $1m into Kan -Cern Limited. And na dis money IMF stop wey Balogun yarn am say him go fit pull out for am. Den even say the bad guy form say na him be Oga of EFCC, Ibrahim Lamorde, and used him name to collect extort money from his victm.

No comments: