The man of God wey popular well well from Bahama, Dr. Myles
Munroe, who still be motivational speaker join don kpain for inside plane crash
o. Tori yarn us say he kpain together with nine other pipu wey include him
wife. Dem say the crash shele when dem Lear Jet wan land for Grand Bahama
Island.
According to one of him padi, Billy Wilson , na to dey
spread he kingdom of Christ bin him assignment when he bin dey alive. Another
report even yarn say dem daughter, Charisa follow die for inside the accident.
Munroe na 60 years old wen he kpain and he don write many many books. He talk
for one conference wey happen early dis year say God need pipu before he go fit put mouth or
body for wetin dey happen on earth…therefore nothing go fit happen on earth if
a human being no gree, na so una get power reach. May God grant am rest
forever.

No comments:
Post a Comment