Dem don send am message go prison o, the pastor wey dey in
charge of Hepzibah Assembly of all Nations International, for 2 Arogbo Lane,
off Odunbaku Street, Iju Ishaga, Pastor Solomon Eze who be 32 years old and a
pikin of Eka, Delta State, south south Nigeria, on top say he ruff handle one 11-year
old girl for Iju Ishaga, a suburb of Lagos State, southwest Nigeria.
Pastor Eze we hear say don first format the pikin mama say
death arrow dey find her for her dommot and na him make the poor woman dey stay
for the church with her pikins dem and na for there the yeye pastor minister
unto the 11 year old girl and even give am belle join. Gbege shele wen the mama start to dey see some
kain strange behaviour by her daughter who dey complain of stomach pain and dey
show signs of malaria. According to the mama, she halla one nurse who come
treat am for malaria, but the thing no gree stop until dem go do scan wey show
say the baby don get belle and when dem ask am who be the gonfabi wey chop her
unripe yam, she say na Pastor Eze. When hand touch am well she yarn say na the
Pastor Eze give am holy water to drink and even give am one red thing to take rub
on her face. She say na wetin she know reach be that when she open her eyes
nko, Pastor don dey on top her dey do her strong thing and say na kpain she go
kpain if she yarn anybody.
Dem report the mata for Iju Police Station and after police
shine light for the matter , dem show Pastor Eze face for one Snr Magistrates’
Court, Abule Egba. The prosecutor, Inspector Rachael Williams, yarn the court say
sometimes in August, 2014, na him Pastor Eze do the bad ministration.

No comments:
Post a Comment