Yobe State Government don carry vexnation close down abi na
close up all public and private schools for dem state on top the bomb wey blow
for Government Science Secondary School, Potiskum for the state where 48
students for kpain and 79 students woundjure.
The Oga commissioner of education for the state polongo yesterday say na immediately make dem close the school o, he yarn say dem decide to close the schools to make dem fit provide better security wey go fit guarantee say nothing dey happen to the students, teachers and the school environment all over dem dommot.

No comments:
Post a Comment