Students
wey dey vex yesterday, scatter normal life yesterday for Lagos House, Alausa
wey be office of Governor Babatunde Fashola as per say dem block the entrance
and dem start aluta wey dem take dey talk dem mind on wetin dem call “arbitrary
hike” that is to say increase wey no make sense for dem school fees for the
Lagos State University, LASU.
The
students wey Mr. Sunday Ashefun, lead na
dem bombard the governor office like 1pm and one of the plenty things wey dem
demand na say make the governor sharperly sharperly reduce dem School fees, say
make Federal Government honour the agreement wey dem entered with Colleges of
Education Academic Staff Union, COASU for 2010 plus the one wey dem do with
Academic Staff Union of Polytechnic and other staff unions
The
studentswey carry placard na him dem allow dem enter around 2.30. in the
afternoon. Dem also ask say make dem implement wetin United Nations
Educational, Scientific and Cultural Organisation, UNESCO yarn say na 20 per
cent of budget make government dey carry give education.

No comments:
Post a Comment