Tuesday, April 1, 2014

MAMA WEY DEM RESCUE FOR SOKA DON SHOW AGAIN O




Dem don find, THE 72-year-old mama o, mama Cecelia Obaikhena, who dem kidnapped for Edo State and keep for inside kidnappers’ dommot for Soka wey dey Ibadan and who be say na immediately dem discover the place she miss again.  Dem say na for around toll Gate area for Ibadan dem find am where she dey roam about and na some mechanics for the area who bin don read her mata for newspaper na dem see her catch.


As dem see her na so dem halla one popular radio station for Ibadan plus including the police who run go the place and carry her commot go the Police Headquarters wey dey for Eleyele.
 
Nigerian Tribune don dey try to take know how she miss on the day wey dem rescue dem, but dem say dem no fit understand her o, cos the language wey she dey speak no be here none of dem fit understand am. And the only thing to take proof say na she be the person wey dem kidnap na her photo wey dem publish for inside the Tribune newspaper, wey fit am like xmas cloth.

No comments: