Sunday, March 9, 2014

WELDONE.......JACK BAUER DON SHOW, FEDERAL GOVERNMENT DON INVOLVE CIA AND MI5 FOR BOKO HARAM MATA


E neva too tey wey the New Oga Minister for Defence, Gen. Aliyu Gusau (Rtd)  enter office o, but the bros don dey show say him own levels no be here. News wey dey waka for town now be say the bros don try involve dem oyinbo police, those wey dey kill terrorist and bad guys for inside American film make dem come help us do the boko boys strong thing.


Them say the way dem Boko boys mata dey be, e be like say na those oyinbo go quick catch dem pass. And our new minister I hear say get levels well well and those oyinbo over respect am wella. So him don use him long leg do better pull out for Naija on top the boko boys mata.

I pray make dem send Jack Bauer O or James Bond, Boko Boys don suffer.

No comments: