Sunday, March 9, 2014

NA UNA BE WINSH WEY DEY WORRY PDP, BROS J TELL POLITICIANS WEY COMMOT FOR PDP.


Na wa o, Bros J don dey vex dey talk o, wen he vex loud am say na the politicians wey commot from PDP be the winsh wey first dey worry the party. Na yesterday he talk the mata for Niger State where PDP dey do dem rally for North Central.
 
Presido come buga o, talk am with unusual confidence say him party go take back Kwara and Nassarawa for APC hand in 2015 election. Make we no forget say na PDP bin win Kwara State for last election o, but dem Governor join the 5 Governors wey vex waka leave PDP for APC, but na APC bin win for Nassarawa originally.

Uncle Jona really yab dem for the rally o, he say after those pipu don chop better for PDP for like 11 years na just 2 years to wen dem suppose commot from office dem come realize say PDP no good reach, den come gather dey call dem sef yeye name say dem be progressive, where dem dey progress dey go? He say if na now dem dey talk say dem wan move forward for life, na him be say den dey try talk say all the time wey dem dey PDP dem no dey waka forward. Presido come say make we no just look dem side o cos dem no know wetin dem dey do. Dem just dey change anyhow, say na only PDP be the party wey no gree change since, dem no change dem name, logo and slogan. So na PDP be the way.

Wen Adamu Muazu, PDP chairman go talk him own he say na primary election dem go take select anybody wey wan run for the party in 2015.

No comments: