Sunday, March 9, 2014

WE NO GO GREE MAKE GOVERNMENT SELL OUR REFINERIES O- NLC



On Saturday, for the parry wey dem wonem for National Labour Congress arrange to take celebrate dem International Women's day for Abuja, na there the National President for NLC, Abdulwaheed Omar clear Federal Government say dem no go allow dem sell our refinery to all dem private business owner o.

He say him no sure say Naija pipu don ready for the kasala wey dem go burst if Federal Government reason am say dem go fit sell our refinery to private business pipu. he say den don dey hear gist say all dis pertol wey no dey na scope wey Federal Government dey arrange to take maga us say na condition make dem sell the refinery.

He say make he try yarn us say wetin e mean say dem sell the refineries be say dem go commot hand for petrol mata, so those wey buy am go fit dey use us as dem like, dey shave our head clean as dem like. he say if our Government na beta pipu ni, dem no go wan take us
do that kain yeye play.


No comments: