Na
wa for this Jet O, how e go just try to embarass our Presido....mtcheew! Na on
Saturday the yeye jet no gree fly o, after Uncle Jona don yarn finish for PDP
rally. Him and PDP National Oga, Adamu Muazu, Chief Tony Anenih plus including
some other presido boys climb the yeye jet wey cost plenty money, wave Vice
President, Senate President and others say na go be that o.
But after dem close
the door of the jet, the Jet say for where, if e fly make dem kill am...the
engineers do do do, come down come totori the jet but the yeye jet no gree fly. Na wen dem see day the jet don make up him mind say e no dey fly, dem re-open door for presido. he come bone face come down go enter smaller jet wey bin carry Nnamadi Sambo.
So Sambo come go join David Mark for the jet wey him carry go Niger for the rally. (But come o, one Jet no gree do all of dem? if space no dey sef dem no fit lap?)
Wen dem ask pipu wey dey incharge dem say na heat catch the Jet cos say him na hi-tech. We no go forget say na like 48billion Naira dem don take pamper the 11 presidential jets wey we get for this country for four years now o. Money no dey, money no dey, jet dey increase but
as God pass dem, the Jets no dey gree fly.......lol

No comments:
Post a Comment