The
megaphone for presido,Dr. Reuben Abati don try clear the air on top wetin many
pipu dey yarn since say dem no do well as dem give former soldier presido, Gen.
Sanni Abacha for our counrty's 100 year old birthday wen dem do for Abuja last
week.
Abati say the matter no be as pipu dey talk am, say the award wey dem give Abacha no be to hail am for our country money wey he thief or the pipu wey he kill for him time. He say the award bin get different
category, and the category where dem for put Abacha na for those wey don try make Naija still dey. He say we go notice say na so so former presidents full for that category.
He come even tell dem say the award no be to tell pipu say dem be better person a just to tell dem thank you for wetin dem don do, say no be say dem dey tell Abacha thank you for our money wey he thief abi dem dey try tell pipu say e good to chop community money, but dem do am for am cos say Naija no scatter for him time.
Abacha award no dey the same category with Baba Soyinka own.
No comments:
Post a Comment