Sunday, March 9, 2014

IF DEM BORN UNA WELL NO INCLUDE US FOR UNA CONFAB LIST- ITSEKIRI AND OGONI PIPU VEX.


Iwere Development Association (IDA) wey be meeting for Itsekiri pipu and Movement for the survival of Ogaoni pipu (MOSOP) wey be Ogoni pipu's meeting don talk am on Saturday say Federal Government no know where dey pain dem as den no gree put dem name for list of pipu wey dey go the Confab wey dey start on March 17.

Itsekiri pipu no just wan hear as dem don talk say if dem born Federal Government, Delta State, Edo State and dem leaders for South South well, make dem no put dem name for inside the list within 48hours dem go see wetin dem go do dem, infact one of dem leaders say na waka dem go waka commot for Naija (where dem go come pass commot), but dem Ogoni pipu say dem go first do dem meeting before dem go know wetin dem go do.

Dem say if no be magmmago wey dem wan do, e get as dem go fit do am wey every tribe for this country go get person for the confab, say dem no just gree for the list at all. Ogoni pipu come even rewind and mutiply the matter wen dem say e be like say the government of Bros J dey beef dem as dem bone Ken Saro Wiwa wey be dem beta pikin for the 100years birthday award wey dem do, and as dem no come put dem name for the list again, e just show say dem dey beef Ogoni pipu.

But Sha o, Oga Governor for Delta State don tell dem make dem relax say dem don dey find solution. Una beta do o, ehn ehn.

No comments: