Miss Simplicity - Yes o I don bring one tori wey totori my body to take nack una door today o..
Na Ivie Okujaye wey be one ogbonge Nollywood actress nd her husband wey be Ezie Egbo naim don welcome new girl pikin for their life o..
D actress no fit hold her joy o base on sey she born safely o nd sey d pikin com life one day before her husband birthday o, dat is to sey Ivie husband birthday na today wey be July 2nd o nd d Ivie born yestaday wey be July 1st o..
Ivie come sama d media wit pinshures where d papa take carry d small girl pikin nd dem two make sense for d pinshure nd na so we for TPN dey tok sey congratulobia to d actress nd her family oooo....
Saturday, July 2, 2016
HALLELUYAH! BABA GOD DON SAMA IVIE OKUJAYE WIT OGBONGE BLESSING O
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment