Friday, June 24, 2016

SEE WETIN MAKE TONTO DIKEH TOK SEY SHE DEY HAPI O



Miss Simplicity - Na so na so, Tonto Dike Churchill wey be actress nd mama of one pikin don kawasaka enta d gang of Genevieve Nnaji, Funke Akindele nd Tiwa Savage base on sey she too don nack one million followers on top Instagram o nd she dey thank her fans wella as dem stand for her back gidigba o..

 D actress sama her fans wit one selfie o nd on top ham she write sey she thank everybody wey dey follow her o nd pipu wey stay by her wey she dey go thru bad nd gud times for d industry o..she com still tok sey she don dance dance bcos of dis gud news o nd she tok sey she dey pray sey make Baba God o, make He bless all of dem... Yes o na dis tori make we all for TPN dey tok sey congratulobia ma'am nd sey God go dey give her d wisdom to take dey do beta film wey go make her followers plenty well well oooo.


No comments: