OGINI BERNARD - No be small thin on Friday oo as d Pipu wey go pray for d Muslim community mosque for USA enter one trouser with d insect wey dem dey call bee. News gather say dem begin run helter-skelter frm d prayer ground as e be say d bee dem Don build three bedroom flat d arena wey dem dey pray. Na bee expert na hin come
help dem move d bee commot frm der as all of dem dey use blanket cover body run. Na only one man case different as hin body rise like rice wey just done. Na hopistal e meet hinsef as e dey receive treatment der. Toor, make Baba God dey save us O, especially pipu wey dey serve am well like dis.
No comments:
Post a Comment