Monday, June 13, 2016

SEE WETIN DEATH DO GIVE SEANCOR DARE NUGA...

Miss Simplicity - Seancor Dare Nuga wey be juju singer naim tori dey nack us sey death don snatch him wife take for him hand yestaday wey be June 12, 2016.
Seancor bin dey for US dey do music tour wen he receive d news sey him wife don kpain o. D wife wey e name be Aduragbemi Banjo wey don born two pikin for Seancor naim suppose go meet her husband for America for June 24 o bt now dat one no go possible again as death don enta their house for Ipaja com carry her o..... Na wa o, death don do e handwork again o, Hmmm we for TPN dey pray sey make Baba God o, make He give d family d strength to take bear dis loss O.

No comments: