Monday, June 6, 2016

PROUD PAPA...READ ALL THE NAMES WEY PETERU DON OFFICIALLY SAMA HIM PIKIN

As per confirm Yoruba boy, popular fine boy Comedian, Peteru wey him wife born last Sunday for United State of America don officially carry names give him baby boy, he don first yarn us say the pikin name go be King Bryan when he dey polongo say him buriful wife don born. But as yoruba culture say na afta 8 days, he don Loud the full names yesterday on top him social media handles... The other names of King Bryan as him proud Papa polongo am na... Ireoluwatomiwa, Ayomide, Ayomikun, Oluwaseunrerefunmi,  Oluwapelumi, Emanuel, Oluwasikemi..... He come still sama am some beta nicknames wey he take hashtag do  #TheSpecialOne #GreatSon #noble

No comments: