One woman wey just born plus her pikin na him don get accident wey dem say na one gonfabi police cause am when he wan collect N100 from one Okadaman, for Ondo town wey dey Ondo State.
Person wey dey there see am say gbege happen when one team of anti-crime police officers wey dey for one of the police stations for the town go block road for one of the major roads. Tori yarn us say one of the officers, when he dey try to stop the go drag the pikin and him Mama commit on top the Okada wey dey move. Dem sharperly rush the pikin and him Mama go the hospital, na him make Okada pipu do Aluta say dem no gree again for police make dem dey collect money from dem anyhow. Tori yarn us say the Aluta shele around 9:30a.m. and na dem Okada pipu Oga lead am. We hear say na the 3 divisional police stations for the town. Megaphone for Okadamen, Timilehin Akinrolabu, yab wetin the police pipu do, wey he talk say dey block road anyhow dey collect money from pipu anyhow for the town.
Monday, June 20, 2016
POLICE FALL WOMAN AND HER PIKIN FROM OKADA ON TOP HOW MUCH?
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment