Olajumoke Orisaguna wey bin dey sell bread before she turn model, and her husband, Sunday plus 2 children, Grace and Precious go move enter dem beta house for Surulere (Lagos) this week. Pipu wey close to Sugimoto Construction, the company wey get the house and wey go pay for am for five years, say na small small things remain wey dem dey do for the house, and told us that very soon the 3 –bedroom pad go ready finish. So Olajumoke don dey ready to move commot from the hotel where he dey start for Sabo, Yaba (Lagos) where she dey stay since she blow. Before God remember her, she bin dey follow pipu stay for Liberty Bakery wey dey Commercial Avenue for Sabo with plenty other pipu wey dem dey gather sell bread. Once again we day congratulobia to Olajumoke.
No comments:
Post a Comment