Monday, June 20, 2016

NAIJA REPS ASHAWO SURUTU : DOGARA NEVER FORM COMMITTEE O

SPEAKER for the House of Representatives, Yakubu Dogara, never carry the mata give any committee abi arrange any kain panel to shine light on top the mata say we Oga Reps go mis-do for as dem dey scope ashawo, anoda of dem even wan hayaj babe from back for Ohio, United States of America, USA, when dem go do international leadership programme. Dogara bin don talk am for weekend say the 3 lawmakers never do anything bad until any panel or committee fit prove am say na true true dem do am. The 3 members, according to the letter from the U.S. Ambassador to Nigeria, Mr. James Entwistle wey he send give the Speaker, are Mohammed Garba Gololo (APC, Bauchi); Samuel Ikon (PDP, Akwa Ibom) and Mark Gbillah (APC, Benue). Entwistle for inside hin letter say the 3 Oga Reps wan take scope chop dodo from ashawo and one of dem one take by force chop hotel house girl dodo. One of the lawmakers, Gbillah say dem 3 go dey yarn on top the mata for one press conference and dem go take action as dem suppose.

No comments: