Base on say dem kpain like 15 pipu for Ogun State by some pipu wey dem suspect say dem be militants from the Niger Delta area, the State oga of Police, Abdulmajid Ali, yesterday confirm say the militants dey seriously find if dem fit hide dem head for the state. The Oga police, wey follow news pipu yarn for Abeokuta on phone say militants no fit do well again for the Niger Delta region as soldiers don plenty die for dem dommot. Ali, wey yarn based on the kasala wey burst on Friday for Imushin community for Ogijo area for the state, say make dem take the mata serious o. Tori yarn us say over 100 militants, wey gbege the community on Friday night, where dem for kpain 15 pipu as dem just dey shoot anyhow even woundjure plenty others. But Oga say na lie o, na only 3 pipu dem kpain.
No comments:
Post a Comment