Wednesday, June 1, 2016

MY PIKIN SYRUP : COURT NACK 2 PIPU 7-YEARS FOR PRISON

The Court of Appeal wey chuk yansh for Lasgidi nahin don confirm the judgment of one Lagos High Court, wey sentence two employees of Barewa Pharmaceutical Company Limited to seven years imprisonment each because why dem sell contaminated teething syrup- "My Pikin".The contaminated syrup nahin dem say be the reason why some small small babies dem don port go heaven. For one  unanimous decision delivered by Justice Chinwe Iyozoba yesterday, the Appeal Court yan say samples of the contaminated drug nahin dem don tested for ons lab, plus say the process clear, smooth plus no need deyooo for additional scientific evidence wey the convicts beg for. After after, nahin the court con yan say the pipu so dem gas go chill for cell for seven years pere bscause say wetin dem do no mak sense at all.

No comments: