Wednesday, June 1, 2016

FG DEY WORK TO SEE SAY TO DO BUSINESS FOR NAIJA EASY WELLA – MINISTER

We Minister for Trade, Investment plus Industry, Mr Okechukwu Enelamah, yan say one of the koko of government na to promote the ease of doing business for we obodo Nigeria. Mr Enelamah yan dis one for one  public hearing yesterday ontop two consolidated bills wey the House of Representatives Committee on Commerce organised sake of say dem wan ensure say fairness dey for economic activities for Nigeria. The Federal Competition plus Consumer Protection Bill nahin one  establish one commission wey go dey regulate competitive activities for every sector for we economy. The bill, wey the Speaker of the House of Representatives, Honourable Yakubu Dogara co-sponsore so, nahin dem plan sake of say dem one bagin promot plus protect  competitive market from unjust business practices. The Chairman of the House Committee on Commerce, Honourable Sylvester Ogbaga, an the bill so na hin go aid diversification of we Naija economy plus create jobs.

No comments: