Wednesday, June 1, 2016

MASSOB ALUTA NO MAKE SENSE AT ALL - DEPUTY SENATE PRESIDO

The Deputy Senate Presido, Mr Ike Ekweremadu, don condemned how dem kpain young men plus women by security pipu for parts of the South-east Nigeria. For dem meeting inside the Senate yesterday, Senator Ekweremadu yan say make members begin show face ontop wetin shelle for the aluta wey be say na from the place 2 police port go heaven plus many many people injure. The Deputy Presido for the Senate con dey yan say we country don face many many killing for different different part so make security pipu dey take am softly anytime wey dem reason say yawa wan gas for one area or part of we obodo Naija.

No comments: