Thursday, June 2, 2016

(FOTO)SEE HOW UCHE JOMBO TAKE SHOW MAMA TO PINKIN LOVE OOOO....



Miss Simplicity- Uche Jombo wey marry Kenny Rodriguez for 2012, wey suffer many miscarriage before she come welcome her bundle of joy last last for Thursday May 28, 2015 for US nd wey do d pikin dedication for Houston, Texas afta sum days, na one of Nollywood ogbonge actress o. Her pikin, Mathew Rodriguez clock one for May 28 o nd Uche Jombo, her husband, family, close friends nd Omoni Oboli wey be d pikin godmother tanda gidigba for Mathew birthday... Bt d tin wey dey noteworthy for dis ogbonge actress be sey even tho she dey always dey busy with many activities, she dey always get time to spend wit her pikin since wey she born ham. Uche Jombo na one woman wey go fit give up any tin wey she dey do make she for fit focus on Mathew o. She be one woman wey cherish dis tin wey we dey call Motherhood o... Na dis tin make we for TPN com tok sey e go make sense if we sama una wit sum pinshures wey Uche Jombo dey take wen she dey spend time wit Mathew... Make una relax wella nd take time see d love nd tender affection wey dey Uche eyes for all d pinshures...



No comments: