Wednesday, June 15, 2016

LMAO.... GOD DON CATCH FAKE SOLDIER WEY DEY SELL FAKE SOLDIER FORM FOR OSUN

Nigeria Peace Corps for Osun State Command don catch one 26-year-old gonfabi wey dem suspect say na fake soldier, Sulaimon Tajudeen, and hin Don confess winsh say him don see   N137,000 from say he dey sell fake forms give pipu wey wan become soldier. Tori yarn us say dem catch Tajudeen for Oke-Baale area of Osogbo, the state capital. Where he for dey lie say na one cantonment for the Ojo area of Ibadan, Oyo State he for dey serve. We hear say Tajudeen sell fake form give one Oladapo for  N27,500. He still collect N13,500 from 2 other pipu ; N36,000, N15,000 and N4,000 from another 3 pipu. Tajudeen say true true he wan become soldier he had wanted to become a soldier. The Provost, NPC, Osun State Command, Oluwaseyi Akintayo, say dem don carry the suspect give military pipu for Ede, Osun State, make dem ask am more questions... Chaii...I pity the guy life sha.

No comments: