Wednesday, June 15, 2016

PEKELE PEKELE : RCCG SECURITY MAN TAKE DADDY G. O. NAME DO MAGOMAGO

One security guard wey dey work for Redeemed Christian Church of God, Awobola Babatunde, na him dem don show him face for Ebute Meta Chief Magistrate Court for Lagos. Tori yarn us say the guy go  open one bank account with the name of Daddy, G. O., Pastor E.A. Adeboye. The 32 year old bad guy wey dem no Sabi him house, na him dey face four offence of day he thief, impersonate, conspiracy, plus say he even wan do wayo collect cheque for N600,000. When dem ask am, he say him hand pure O. Police wey carry am come court, Insp. Aighoi Gbemileke, yarn the court say the bad guy with some pipu wey don dey miss do the bad thing on June 6 for Redemption Way, Ebute Meta, around 9am. He say dem thief one Fidelity Bank cheque wey him money be like N600,000 wey be for Adeboye. The guy go lie say na him be Pastor Adebayo, come go open savings account for Fidelity Bank wey dey Aguda, Surulere. He open the account to collect the cheque, make he come take the cash step down. Babatunde still open the account so he go fit dey thief money from the church cos dem wan dey pay more cheques enter the account. The Magistrate, Mrs. Bola Folarin-Williams, sha give am bail for N100, 000 with two sureties for same money and dem gats be him blood relations. She come push the mata go August 4.

No comments: