Kano State Police Command don confirm am say dem don catch 32 pipu wey dey kidnap come still save 21 pipu wey dey dem dommot. Wen dem dey show face the bad pipu face, the Kano State Police Commissioner, Maigari Dikko, yan say one of the suspects plus one victim kpainoo during the rescue operation. Channels Television correspondent yan say many many big big weapon na hin the police see collect from the kidnappers so. Kano state nahin don dey suffer from kidnappers plus armed robbery tey tey so tey about 35 cases nahin pipu don repprt to police den for just three months. According to dem CP Maigari Dikko, E yan say na the support wey the people of Kano State, dey give hin pipu nahin make am dey posibu to catch all of dem. Last last E con yan say all the pipu wey dem catch in so nahin dem go show face for court very soon.
No comments:
Post a Comment