Wednesday, June 1, 2016

CONGRATULOBIA... LAFUP YAFF BORN COMPLETE TEAM, AS HIM BABY GIRL DON SHOW

Popular Naija Comedian wey start him hustle from Ibadan, still be OAP join and organizer for Lafup Live wey dey shele for Ibadan every 26th December don complete him squad as per wetin Yoruba pipu believe. Yoruba pipu believe say once you born boy, born girl, your team don complete be dat. Na so e be for Lafup wey God don sama him and him family, correct baby girl after he don first take Seal, dem baby boy decorate dem life. LAFUP wey just show back Naija afta he follow King of Comedy, ALI BABA do him 4 city tour for USA. LAFUP climb on top him Instagram take polongo the good news with message wey be like poem and we say congratulobia to the Ogundipe family. But come O,  wetin ALI BABA take select comedians wey follow am travel, cos na after the tour, Peteru wife born King Bryan, now Lafup wife don born too. Make I give una wey be Comedian secret, if you wan follow ALI BABA do tour, make sure say your wife don get Belle. All of us from TPN say congratulobia to Lafup and him buriful wife and of course the big Bros, Seal wey don collect aburo.

No comments: